The guy come back and hin give me d Gen..i no pay am anything at all..i prayed for d guy….Tho d Gen don old gan and oil just day gooze from the body.i carry am like that from pastor djeezy syd reach my side.. The distance reach 3 kilometers.. i day drop am day rest for road.Day drop am day rest for road.
People just day look me for road.me sef dey look dem.
” My guy ,ur gen spoil” na wetin guys dey ask me be that
” yes” i no get strength to day talk long tori again..By d time wey i don almost reach House,
i don be like mechanic as na all my cloth don dirty but me i no send,ichinbong na hin be my inspiration.
Next thing as i reach house,i buy card call Emusmith make hin con repair d spoilt fan and Wristbangle to con repair d toilet, way no day gree flush well.
I no fit day kpansh inside heat ooo..
” Oga we no fit repair am today,na inner wiring spoil”
Haa..no be today dat one go happen.i paid his transport fare from there go there market and come back.wetin dem day sell for 1k d guy call am 2500 for me.As i no fit go buy am myself,i give emusmith.
The toilet guy no give me probelm,he just come do hin own work comot as we gather dey make jest…He knew i was quite happy….Fan fix .Toilet fixed .everything getting in shape..
I think am ready to receive ichinbong.
I con start d cleaning proper.Comot bed.comot carpet ,dust everywhere. comot cow webs, comot all dirty dirty tins and everything.. Clean d whole house proper..
The kind sweeping and cleaning wey i never clean since i packed in 3 years ago,na hin i give the room dat day.
I sharply wash d two Cottons ,hang am for outside.. As per say my bed don tear tear and d thing don soft. as usual i borrow foam from MrCork ,put am under for more thickness.. Con spray perfume for d bed sheet put am for there.. Ehnn i think all is set now. All dese while i never see a single thing put for mouth.
Everything don set..I don pack Spartacus.game of thrones and all dis erotic movies full lapi incase she wan watch film..dat one go ginger her up.
Related episodes
{{comment.anon_name ?? comment.full_name}}
{{timeAgo(comment.date_added)}}
{{comment.body}}
{{subComment.anon_name ?? subComment.full_name}}
{{timeAgo(subComment.date_added)}}
{{subComment.body}}