"Allow ads" and Popups to avoid redirection of your browsers.

Must Read: How I Take Service A

Episode 7 years ago

Must Read: How I Take Service A

Tuesday mornin. 6:00am 4 parade ground.



We don do prayers finish, muslim and christian
prayers. (1 short guy wey dey by my side de hala
wit vex say dose officials suppose know say nobe
only muslim and christian dey 4 camp dia. if dem
vex am he go enta villa go kari im papa shrine dump
am 4 field dia and nobodi go do anytin). As usual,
soldiers de waka up and down de monitor evribodi,
dose wey de ansa call, dose wey sidon, dose wey de
tok, dose wey de chew gum and oda small small
offence. Diffrent Officials de address us, de tell us
mak we dey alert and kiaful say town no safe again,
dose bad guys de try evritin possible mak dem enta
dat camp bt mak we no fear, evriwia dey secure..



E com finally reach d last official to address us dat
mornin. Camp commandant. He kari microfone.



De commandant wey be say, if he wan speak b4, he go
1st stat de yab coppas de joke wit us. Dis mornin he
jus kari mic, he no tok 4 sum seconds, he jus de luk
around, next tin he stat de tok..
…” I don see say dis play wey me and una de play
don mak una take me 4 granted….I don de laff too
much. I node treat una de way military men de treat
civillians, I de take all of una as my pikin. I node
punish una becos I no say evribodi na graduate so I
xpect say una gode behave urselfs. But sum
pple !!!!…sum useless copas no jst like as I de give
una free hand here !!!….. They don swear say dem
must break de golden rule wey we get 4 dis
camp!!!!…. Rules wey dey b4 una com and e go still
remain afta una comot.!!! Dis camp na just 3weeks.




Only 3 weeks Naim una no fit control una prick and
toto…., small small girls wey una be naim toto don
de sweet una lyk sugar…..I tok all dis tins d 1st day
una com camp. I read all d rules and regulation 4
una. I sure say all of u de rememba de main point
wey I bin tok wella dat day…. I spend close to
40mins dat day 4 dis point alone…..make nobodi
furck 4 dis camp.”‘
Evriwia quiet imediatly lyk burial ground. Evribodi
jus silent. commandant neva yarn wit vex lyk dis
b4, he neva even shout giv anybodi since we com
camp. Why sum pple no fit jus obey comon
instruction, upon say comandant de giv us free
hand yet sum pple still de tak am 4 granted.


Nawao.


De comandant continue….


“” Yesterday morning, as all of us de do mornin
devotion 4 field here, naim sum coppas wey feel say
dem wise and smart pass we wey be military men,
dey 4 boys hostel baffroom de do wetin dia mama
and papa teach dem. I warn una about dis
nonsense. I warn una say mak una no furck 4 my
camp bt una tink say una wise. I go use dis case
teach oda pple wey get dis kain plans beta lesson.



E go mak oda pple wey de plan 2 furck 2 tink twice…”



Heey !!! My heart jus de beat. Dis man wan bring
up our case again abi na anoda 1?. But wait o…our
own hapun on sunday bt he tok say dis one na
ystday.



Our own na 4nite bt he say dis one na mornin.



Our own na inside bush but he de tok say dis one
hapun 4 boy’s hostel baffroom. Ok o. My mind com
rest small. but if say dem catch oda pple wey de
furck, I 4 don hear am, biggy 4 don hear
am….maybe dis man wan use style change details
so dat me, biggy and bekky nogo get chance run
comot. Hmmm.



De man continue… ( by den day don break wella )
“” I giv evri soldier here 15 mins to go round evri
hostel again, both male and female, check weda evri
coppa don comot field here. Search evriwia,
kitchen, toilet….evriwia..”



De comandant sidon 4 chair de discus wit oda
officials. My heart jus de beat wit full force, enuff
sweat cova my face( ontop d early mornin cold o),
my belle stat de turn me, my legs no gree kari my
bodi again omo I jus bend down sidon 4 grass dia.



20mins leta naim de army men com bak. One of
dem kari 2 coppas (boys) wey bin claim say dem
dey very sick earlier dat mornin. One of dem even
faint as de army men de try force am 2 go mornin
parade, de oda one vomit naim dem decide 2 leav
dem 4 hostel. As de army men go bak hostel now
naim dem catch 2 of dem de play gambling, wit dia
squadron dry gin and cigarette inside hostel.



De
camp commandat jus say mak dem kari bucket wey
water full 4 head, stand 4 middle of field dia till we
finish mornin parade.
De army men tell am say no oda pesin dey hostel
again apart 4rm dose two gamblers. Naim he stat
again…
“” De pple wey I de tok know diasef… I de giv u 10
seconds mak una com middle of dis field now….if u
no comot afta 10 seconds….wetin u see naim u go
take….10…..9..8…..7…6…5…4….3….2…..”
De commandant finish count, de pesin (abi na me
sef) no gree comot naim he comot paper wey dey im
pocket Mak he call de names wey dey dai. Na den I
com rememba say rambo rite our names down 4
paper dat nite wey he catch us 4 bush. De
commnadant unfold de paper wella, den continue….
“” OCHUKO AYENI !!!! Come out hia now. “”………

Previous Episode

Must Read: How I Take Service A

Next Episode

Must Read: How I Take Service A

What's your rating?
0
{{ratingsCount}} Votes


Related episodes
Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 9
episode | 6 years ago

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 9

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 8
episode | 6 years ago

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 8

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 7
episode | 6 years ago

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 7

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 6
episode | 6 years ago

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 6