SEVEN DAYS TO MAKE A MAN - Season 2 - Episode 4
SEVEN DAYS TO MAKE A MAN - Season 2 - Episode 4
☆☆
TRAINING
STAGE 1
We march like ecomog soldier to the back gate , once we just reach the gate, dem open am and througout that day rain been dey fall , chai omo come see mould and dirt , plus grass i mean those grass we dey scratch person like mad chai na wetin man won joke with be this?
Just then i heard solo’s voice i turn round come see am with david dey shake, i just shake my head , no blame them sha nobi their fault.
I was still thinking when i heard
“all of you you start coming out according to your platoon digits”
platoon 1 dive enter the mould and crawling things began. Soon it got to my platoon and just as my body touch the mouldy water and earth, na so i jump up and wetin come tell me to yansh down na one hot whipe wey the nearby provost tear me.
Chai i don die o me tell ona say the koboko really enter me like mad. I no fit cry but tears just dey come out from my eyes.
Just then the provost come throw us song
“this is the way i wanted to be o, this is the way i wanted to , hey i want to be a soldier hey i want to be a rugged , hey hey hey i want to be a soldier, this is the way i wanted to be”
the song come boost my moral, nai i come dey crawl as if i get 9 lives left. Soon i complet stage one .
{{comment.anon_name ?? comment.full_name}}
{{timeAgo(comment.date_added)}}
{{comment.body}}
{{subComment.anon_name ?? subComment.full_name}}
{{timeAgo(subComment.date_added)}}
{{subComment.body}}