SEVEN DAYS TO MAKE A MAN - Season 2 - Episode 10
SEVEN DAYS TO MAKE A MAN - Season 2 - Episode 10
☆☆
DAY 4
TRAINING
STAGE 7
TIME: 12:00AM
AS I DEY BUSY DEY CRY MY HEART OUT NAI I JUST DECIDE TO CHECK TIME, OMG! WE DON LAND FOR DAY 4 O, NAI I COME DECIDE TO BE A MAN , I STAND UP COME FROG JUMP ENTER STAGE 7.
“OYA ALL OF YOU YANSH DOWN!”
THE MAD CP YELLED, NAI WE OBEY AM COME SIT DOWN FOR THE BARE POTOPOTO GRASS {MOULDY GRASS}, NAI DEM COME GIVE US WATERY BEANS TO EAT. THE BEANS STILL DEY DISCHARGE VAPOUR DEM NO GIVE US SPOON, AND NA BARE HANDS WE USE EAT AM {GUYS OUR HANDS DIRTY PASS PERSON WEY BEEN DEY WORK FOR FARM OWN SELF}
DEM COME GIVE US 120 SECONDS TO USE FINISH AM {2 MINUTES, FOR THOSE OF ONA WEY NO KNOW MATHS AND CAN’T CONVERT IT O, I NO MENTION NAMES O , LOL} NAI WE START TO DIG INTO THE BEANS WITH OUR BARE HANDS…
ME FINISH MY OWN UNDER 10 SECONDS {IF ONA THINK SAY I DEY LIE MAKE ONA CALL ME MAKE I COME ONA HOUSE COME EAT, AS LONG AS ONA NO POISONE ME O, AND MAKE ONA NO CALL ME BUSH MAN IF I EAT TOO FAST , LOL.}
WHEN DEM COME NOTICE SAY WE DON EAT FINISH DEM COME TELL US TO USE THE BEANS HANDS RUB FOR OUR SHINING HEADS. I WAS LIKE A WHAT?!!!
.
.
.
.
{{comment.anon_name ?? comment.full_name}}
{{timeAgo(comment.date_added)}}
{{comment.body}}
{{subComment.anon_name ?? subComment.full_name}}
{{timeAgo(subComment.date_added)}}
{{subComment.body}}