Must Read: How A Girl

Episode 7 years ago

Must Read: How A Girl

People day enter day look me day shook head, me sef look dem back they shook head.

” What’s that thing on your face”,Did u injure yourself ” the backo trouser guy ask me..

” Nothing to concern yourself with ,” i responded.

The backo bag trouser guy dey look me sef day look am. .Look me i look you.Man no go wetin ————- ( Fill in d gap ).

The concontion rice day make stomach sing Tonto dikeh songs since morning .My guys be day call me for lectures ,i no pick infact he reach one stage way i just switch phone off .
The hunger wey day gbab me plus d Kind eye people take dey look me reach make i vex comot d Church but no. Am here for a reason.

Na on top d chair i be don sleep day dream of how i go take spend my 40k winning when i just waka comot from d sleep enter reality.. Haa 2 hrs don nak..30 minutes join am sef.

I look around for the Backo trousers guy i no see am ..Haha..I bin don day fear untill i bin see d Guy day come inside with small small pikin speedy biscuit and purewater,they crack d thing chop..

” U mind “..he said offering the speedy biscuit to me..

Dis one day craze..Na speedy biscuit day do me naw

” Pls where is d pastor ” he should be through by now ” i said as calmly as i could..

” haa brother…sorry ..dont u think u shld come back d next day…I think he will

He will be kini?? See i cant come back d next day oo..I must see d man of God today.. Lai lai..

Even the people wey day read this tori wan sabi wetin i wan go do for d man of God syd..

U con say make i come back the next day.. Next day kor. days of d future past ni. oga i no day come back kan kan.

Ok calm down sir..am just playing with u .
seeing dat u are so moody.We are suppose to be happy in d house of d lord “” hehe hehe .. ” He said.

I just day look d man.. When he turn
Basketmouth or Bovi wey dey crack jokes .. No be your fault. Na wetin carry me come here.

You can now see d pastor… in his office.. .. He said as he beckoned o

At last…I standa slowly and Walked into the pastor Seun office. . I enter meet book for everywhere, i greet am ..The man no greet me.. He just use hand show me chair.. He was a new pastor..No be d one way day church be this during d s*x scandal.
.
Well done sir …

Yes how may i help u

” I am boo

” Osin ..yes av heard about u ..Like i said earlier how may i help u….

..??

Hmmn Sir i have a deep probelm i will like to share with u sir.

Na so i start i start my formulated tori . I tell am about my life . How i take dey knack babes and everything and how i day live a sinful life .

I narrated amidst tears how i met God and received Christ.. and how i am now a new being in Christ.

I jump enter how i still single and how getting a life partner be don day cause me wahala for me all dese days and how Av been praying to God for my own wife. and life partner.

The man just day look me.he no say a single word..me sef day look ,hope say dis man day chop my lies sha.

Previous Episode

Must Read: How A Girl

Next Episode

Must Read: How A Girl

What's your rating?
0
{{ratingsCount}} Votes


Related episodes
Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 2
episode | 5 years ago

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 2

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 1
episode | 5 years ago

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 1

Black Spot S02E05 - The girl and the dead
episode | 4 years ago

Black Spot S02E05 - The girl and the dead

The Flash 2014 S05E21 - The Girl With The Red Lightning
episode | 5 years ago

The Flash 2014 S05E21 - The Girl With The Red Lightning