Must Read: How A Girl

Episode 7 years ago

Must Read: How A Girl

( Going The Spiritual way.. scoping the man of God )

Na the Fourth day be this ooo.My guys don day ask me how far with the package …dem sabi say he no day take me long like this before parole go click.

Rokiatu no take me pass 2 days even almighty Ishilove na d first day we meet i chop am,na only tantalizers meat pie and Cold Fayrouz he cost me .why dis inchinbong own wan con different. Na ??.

I sha dey whine dem sey work is in progress ,then show dem our previous chats .dey sef dey nod day await result.

Me wey i no get myself..Na different foolish ideas just day come my brain..

Make i try my luck with this one.

The next day, I chop the concontion rice wey i cook yesternight…I no finish am as salt too much.. i sharply do rub and shine,Wear my nigerian super eagles Jersey ,jeans and timbaland.

Spray my aboki perfume,rub damatol full my hair and set out to ichinbong’s fellowship center..

As i dey waka go the syd. Na different things day come my mind..me me?? .Angel..Na me con turn person wey day waka about .day struggle on top one babe ?? OK.. no probelm.

If no be something way make crayfish bend .Me to dat kind ichinbong .

God sabi when last i don step my leg for inside dis church.The last time wey i con scout for babes. Na d first female usher i meet for door discourage.

..How usher go wear blue top on top red skirt join am with yellow socks con finish any form of Attractiveness she suppose get with her pink beret ?? Later dem go full vigil say dem no see husband .. “” How u go see husband when your dressing be like person wey no sabi house to support for interhouse sports …. Yeye dey smell

The person i meet for church nearly tear race comot on sighting me.. Me i just bone face enter. Me i no see d guy blame because i don sabi d atrocities wey i commit .. As i day talk say the babes for d church no fine reach. i still manage tear deir three of their choir members including the much loved holy mary ,choir mistress. Sis blessing Ojai.

How d news take spread i no sabi till date ..The matter almost tear d church into two.But dat one na tori for another day.

Brother boo ” The guy abi na man wey i meet for church greeted me.I look am from head to toe as he be like Stick man sweet inside hin Oversized shirt and Backo bag trousers..

” Am not a brother pls “.. i responded

” But brother.. sorry ..we are one body in…

” ( Cuts in ) pls is pastor Seun around…

” Pastor Seun ??

” No pastor lalasticlala..is he around jare ” i said getting impatient

‘ Haa hope there is no probelm ” he said ..
he was Smiling all the time clearly ignorant of his delapitated brown dentition.

‘ Will u get me d man of God or will u keep me waiting.. Isthat what d book of the lord taught u ??

No sorry sir.i will get him now….He said..He beckoned to one sister in the blue shirt and red Skirt uniform and asked her to check the pastor in his office…

Omo dat sister get yansh no be small ..on top all d wahala wey carry me come.i couldnt help but check out dat sister basia as she walk enter pastor office..

” Haa brother boo ..i have a message

” Oga pls i dont want any message…

Haa ok..The sister soon came back and gave a report that d pastor bin day pray for inside room and say he fit take like 2 hrs because na Special Week prayer he day pray today .Haa which kind thing be this.

2 hours ?? Him day pray for the whole school ?? Wich kind level be this naw… Ehn today na
today .I go wait..

Previous Episode

Must Read: How A Girl

Next Episode

Must Read: How A Girl

What's your rating?
0
{{ratingsCount}} Votes


Related episodes
Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 2
episode | 5 years ago

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 2

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 1
episode | 5 years ago

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 1

Black Spot S02E05 - The girl and the dead
episode | 4 years ago

Black Spot S02E05 - The girl and the dead

The Flash 2014 S05E21 - The Girl With The Red Lightning
episode | 5 years ago

The Flash 2014 S05E21 - The Girl With The Red Lightning