Must Read: How A Girl

Episode 7 years ago

Must Read: How A Girl

She ask me if any girl don embarass me like the way she embarass me before .i talk no

.. She narrate how joke134 take spoil me for her face.. Me sef narrate how useless d babe day and we laughed over it.

she ask about my Gf which i tactically evade ( i for talk wetin i tell am but Some guys go day
use am cruise babe about.i no go drop am..
Oobi )

.
We kept on talking and talking..she no even give space before she day reply my message.i send now. 2 seconds she don reply.

..I described my address to her and she told me she wants me to cook rice down for her oo and buy her shawarma.

Shawarma ??. Ichinbong. sharwama ?? Haa. Sharwama no go fit do u oo.Why u want shawarma,when i get better banana for here..

By 11 30 pm,i had to end d chat and wish her a good night rest..And she replied with Kiss and
love smileys .Choi. This girl never sabi anything.
She never sabi wetin go befall her… Kiss and love…Green light toh bad

…I slept heartily with Synord Otubante playing in d background and my manhood kept nodding with REFLEX ACTION in preparation for tomorrow ‘s LA liga match versus ichinbong.

Throughout that night i no balance, i just day change boxers anyhow.. I no fit wait make tomorrow come.

I get some many things i must to put in place before the babe come to ensure an unforgettable experience with Inchinbong babe

I just Cant wait for Tomorrow to Pour.I just cant wait.Tomorrow,the day inchinbong finally visits me. Make tomorrow do sharpaly abeg.

As next day reach like this,na around 5am i don wake up.. i no kukuma see d sleep sleep like that sef .I see say he be like say morning never reach well,make i chill small.i go sleep back.

By d time wey 8 go knack,i don wake up. I wan use the Close up tooth paste .I see say he don finish .I use knife cut am into two.use d one wey remain inside brush mouth well.All d inner and all those corner corner teeth na hin i wash well as i no pity d Tongue sef..

I scrape d thing wella make i no con wan day kiss ,make mouth day smell..After i finish The small close up, i con use the other Oral B toothpaste wey i get,use am brush mouth again.. If one toothpaste no work ,d other go work.

After i brush finish.i used sponge and Dudu osun to scrub away every impunity and dirty dirty wey day for my body. Na almost 1 hour spend for bathroom..Any place wey i fit Scrub na hin i scrub..As i day scrub,dey baff ,na hin i day sing Reminisce Tesojue laleyi.,wafe Ku laleyi

Infact na d kind baff wey person wey day baff am go sabi say d baff wey hin day baff pass oda baff wey hin don dey baff before .

Previous Episode

Must Read: How A Girl

Next Episode

Must Read: How A Girl

What's your rating?
0
{{ratingsCount}} Votes


Related episodes
Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 2
episode | 5 years ago

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 2

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 1
episode | 5 years ago

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 1

Black Spot S02E05 - The girl and the dead
episode | 4 years ago

Black Spot S02E05 - The girl and the dead

The Flash 2014 S05E21 - The Girl With The Red Lightning
episode | 5 years ago

The Flash 2014 S05E21 - The Girl With The Red Lightning