Must Read: How A Girl

Episode 7 years ago

Must Read: How A Girl

I shaved all the hair wey dey my body comot ,both upper and lower region, ..Anything fit shele anytime, wey she go feel like licking the Stick sweet .

She fit go vex comot if na Mangroove Forest she go meet for there,i make sure say everything,clear like Sahara desert… Na Reflex action .

Time no day today ..i get plenty things i must get sharpaly .as soon as possible..

I sharply go bank atm…i go withdraw the last 7 thousand 500 naira wey remain for d account.. One guy wey day beg for transport fare go hin
village,though nobody give am any money.i comot 500 wey day top.give d guy.

From there,i comot go market.

The First thing wey i bin buy na flowers..I buy flowers.. I buy this poster abi na banner wey dem day put for wall for inside house

.I specifically make sure say na d one wey dem day kiss and romance and half Unclad ladies in bikinis day na hin i buy.i buy 3 of that one.

I buy air freshner and better perfume,i buy hanger to arrange all my clothes wey i be no arrange and i buy Foot mat wey i go put for door as i bin no get any before.

After i reach house, i go Mama Peter Store, buy Viagra and two bottles of alomo..con use one leg branch iya shakira alagbo ,na there i con buy 200 naira worth aleto,opa eyin.jedi jedi and Ato pa.

After i buy all this.i go Abigurl and Prettyjo pharmaceutical store and supermarket , go buy condom..Make she no day dey reason me cheap or local ,i buy Original Durex condom…..

He be like set everything don day set small small…

What of the rice wey she wan chop ?? I hustle go market back ..Be like say I get rice for house,I just go buy fish.small meat.tomato.Maggi. ponmo and the rest wey i go use sama d girl better jollof rice. i just day sweat day pespire as i bin day jump from one okada to another.

… Na dere i meet one of my old padis,Edgyslim.

. We greet. talk small and he talk say make he con sabi my house ,say he get one big business way he wan involve me.

..Today ?? oloshi..He no con fix better time,na,around 6 and 7 the bastard go fix again. Destiny destroyer, by d time wey my guy go talk say make he carry wetin hin buy and comot phone collect my number,i don tear comot.

Previous Episode

Must Read: How A Girl

Next Episode

Must Read: How A Girl

What's your rating?
0
{{ratingsCount}} Votes


Related episodes
Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 2
episode | 5 years ago

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 2

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 1
episode | 5 years ago

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 1

Black Spot S02E05 - The girl and the dead
episode | 4 years ago

Black Spot S02E05 - The girl and the dead

The Flash 2014 S05E21 - The Girl With The Red Lightning
episode | 5 years ago

The Flash 2014 S05E21 - The Girl With The Red Lightning